Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

South Africa Don Confam Say Vladmir Putin Go Attend BRICS Meeting Through Internet.

July 21, 2023

South Africa don explain give us say Russian President Vladimir Putin no go chook leg inside the BRICS meeting wey suppose happen for August, but e go dey the meeting from internet. The announcement wey dem yarn us on Wednesday say the Russian leader no go show leg for the meeting dey come up after months of tok-tok wey don dey waka round, as him showing up dey cause one political problem for South Africa wey, as one member of the International Criminal Court(ICC), go get no oda choice dan to handcuff am if dem smell him foot for the country.

During one press tok-tok for the BRICS chairmanship, Deputy Director-General for Asia and Middle East and BRICS Sherpa Anil Sooklal con tell reporters say the choice dem make na to make sure say the meeting go on successfully inside South Africa. Putin dey under arrest order from the ICC for the war crimes wey chook hand with the war for Ukraine.  

More Posts