Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Petroleum Tanker Divers Don Start Protest Round We Country, Dem Don Dey Halla Say Dem Go Comot NUPENG.

November 20, 2023

Petroleum Tanker Drivers (PTD) don talk say dem go waka commot from NUPENG if dem President Williams Akporeha and General-Secretary Afoloabi Olawale no resign. Mr. Gbenga Olawale, wey be Ex-Officio for PTD from Ibadan depot, yan for statement say their members go start nationwide protest to show say dem serious about their request. Dem talk say make PTD members waka with leaves for front of their trucks as warning to NUPENG and police against any interference or harassment of their leaders. Olawale talk say Williams no be NUPENG member and e no get the ability to lead the union. E also yan say Williams put people to collect union revenue wey no dey benefit the union and tanker drivers.

More Posts