Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

The Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) has issued a directive to 11 electricity distribution companies (Discos) across the country, instructing them to refund customers who were incorrectly billed at the new rate.

NERC don order Electricity Distribution Companies make dem refund customers

April 8, 2024

The Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) don give directive to 11 electricity distribution companies (Discos) wey dey across di kontri, say make dem refund customers wey dem bill wrongly for di new rate.

Di commission don give di Discos until Thursday, April 11, 2024, to complete di refunds. Mr. Abba Terab, di Deputy General Manager of Market Competition and Rates for NERC, na im announce dis one for one statement wey dem release on Saturday.

According to Terab, di refunds gatz happen through energy tokens and dem gatz finish am latest by April 11. Additionally, di Discos gatz provide evidence say dem don comply with di Commission latest by April 12.

Apart from di refunds, NERC don instruct all Electricity Distribution Companies make dem give clear and transparent explanation to di customers wey dem affect.

More Posts