UK Prime Minister Don Ready Four Part Plan To Comot Coronavirus Lockdown For England
British Prime Minister, Boris Johnson don list one "cautious" four-part plan wey den wan use take lift di coronavirus lockdown inside England. He go share dis hin finalised "road map" with ministers today Monday, before he go con unveil am give MPs and then lead one news conference by 19:00 GMT.
Dey say, dem dey expect all schools inside England to reopen on March 8 with outdoor after-school sports and activities allowed, and den fit allow up to six people or two households to dey meet outdoors from March 29. Dey say, na batch by batch den go use take comot Rules and den must to meet four conditions at each stage, such as di coronavirus vaccine programme wey go continue to go to plan; dey say Evidence don dey also show say vaccines don dey helep reduce well well di number of people wey dey kpai from di virus tabi di new variants of di coronavirus do not fundamentally change di risk of lifting restrictions.
Related Content
Contact
We are located at 26 Keffi Street, Off Awolowo Road, Ikoyi, Lagos
Telephone:
+234 (0) 1270.1020
+234 (0) 1463.1700
+234 (0) 1463.1701