Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Pres Buhari Don Send FCT & NDDC Budget to House of Reps

November 15, 2022

President Buhari don table the budget of the Federal Capital Territory and the Niger Delta Development Commission wey dem dey suggest give the House of Representatives so dem go fit reason am and give go ahead. The Speaker of the House, Femi Gbajabiamila, read the communications from the President give members for the meeting on Monday. The NDDC 2021 AND 2022, along with the FCT 2022 budget dey enter feferal parliament two months before the year go end .Dem transfer the budgets for time when the House Committee for Public Accounts don clap hand give for the torchlighting of nothing less than 63 organization of the Federal Government because dem go apply illegal budgets.

More Posts