Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

NFF confirms Finidi George as Super Eagles interim coach

NFF don confam Finidi George as Super Eagles interim coach

March 20, 2024

Former Nigeria forward Finidi George go dey in charge of di Super Eagles when dem go jam West African rivals Ghana for international friendly for Marrakech on Friday.

The 52-year-old don be appointed by di NFF to take control as dem get 22 players wey go play against Ghana and Mali for dis month international matches.

As of Tuesday lunchtime, 12 out of di 22 players wey dem expect don land for Morocco’s fourth-biggest city, but defenders Gabriel Osho and Tyronne Ebuehi, plus forwards Victor Osimhen and Taiwo Awoniyi no fit make am because dem get injury.

Di African vice champions go still face Mali for di same Grand Stade de Marrakech on Tuesday, 26th March 2024.

More Posts