US don record 500,000 Covid-19 deaths - Imagine wetin e look like
President Joe Biden don address di nation as di US mark 500,000 deaths from Covid-19, di highest toll of any kontri for di world.
"As a nation, we no fit accept such terrible fate. We need to resist becoming unfeeling to di sorrow," e tok.
Di president and vice-president, and dia spouses, also observe a moment of silence outside di White House during one candle-lighting ceremony.
More dan 28.1 million Americans don dey infected - anoda global record.
US don see more dan twice as many deaths as di next hardest-hit kontri, Brazil.
But na also one kontri wey get di most population.
In terms of deaths per 100,000 population, e dey rank ninth, behind kontries like di UK, Czech Republic, Italy and Portugal, according to Johns Hopkins University
Di first known US death from di virus come on 6 February 2020.
E mean say half a million lives don go in just over one year, more dan di US death tolls from World War I, World War II and di Vietnam War combined
Related Content
Contact
We are located at 49, Ondo Street,
Off Osuntokun Avenue, Old Bodija,
Ibadan, Oyo State, Nigeria.
Telephone:
09015871597
Sales & Marketing
09023753507