Live on air

🎧 Listen Live πŸ”΄

NNPC Tok Say 1.8b Liters Of Fuel Go Dey Until March 2023

February 21, 2023

The Nigerian National Petroleum Company Ltd (NNPC), don tok say dem get 1.805 billion liters of fuel wey dey ground.

Dea spokesman, Malam Garbadeen Muhammad, yarn us for Abuja on Monday say the amount of fuel wey dey ground lyk dis go last up to 30 days. Muhammad con dey explain say 805.35 million liters of fuel don dey dea warehouse round the country, while one billion liters still dey dea containers.

E add say NNPC don drop fat plan so dat better fuel go shele’ from middle of February go March 2023.