Naija Pipu Dey Para For Goment Ontop Plan To Dey Charge 5% VAT Ontop Online Purchase
Some Nigerians for social media dey complain bitterly about di five percent Value Added Tax ontop online buying wey di kontri dey reason to introduce from 2019.
DI CHAIRMO OF DI FEDERAL INLAND REVENUE SERVICE (FIRS) TUNDE FOWLER TOK SAY GOMENT NEVA DECIDE ONTOP DI MATA YET BUT DEM DEY PLAN TO ASK BANKS TO BEGIN CHARGE CUSTOMERS VAT ONTOP ANYTIN WEY DEM BUY ONLINE WIT DIA BANK CARD.
Apart from payment on delivery, di use of banks cards na one of di main ways pipo dey use pay for wetin dem buy online and e fit soon dey attract five percent tax from FIRS.
‘E fit kill e-commerce, cashless policy’
Online buying and selling don begin dey popular for Nigeria, especially as different e-commerce stores dey open almost everyday.
Many Nigerians like dis method of buying because dem no need enta market to buy wetin dem want but some pipo feel say dis tax go destroy e-commerce sector for Nigeria wey still dey try grow and discourage pipo from cashless transactions.
Contact
We are located at 49, Ondo Street,
Off Osuntokun Avenue, Old Bodija,
Ibadan, Oyo State, Nigeria.
Telephone:
09015871597
Sales & Marketing
09023753507